THIS LIFE NO BALANCE

Photo by Samuel Branch on Unsplash

This life no just balance at all. Who get cap no get head, who get head no get cap. Na America matter make me dey reason for broken like this o. Even the name America, na name of full continent o. The continent get south and north, and many countries full there. But when you call America, na one country don kolobi the name. If dem fit too, dem go kolobi the world.

E get one time like that, naim dem issue travel advisory give Nigeria on top COVID-19 and civil unrest! Insult upon injury. E get who go dey issue that kain warning give you, and you go fit reason am. If person wen wear fine cloth dey laugh you sey your cloth tear, you fit gree. But when person wen wear tear tear cloth dey laugh you on top your own cloth wear tear, e just be like crase. Or sey person wen get body odour dey laugh you sey you neva baff?! People wen on top protest sey make dem no dey treat black people like sey we be point and kill come turn am to serious gbege, come dey kpafuka things, na dem dey warn sey civil unrest dey for Nigeria? Abi na only me dey look the yamayama wen happen for that side?

Photo by CDC on Unsplash


Photo by engin akyurt on Unsplash
But make we even fashy the matter of civil unrest first. Even this COVID-19 matter, the way dem respond be like people wen get sense? Abi na only me confuse as dem dey drag matter on top chloroquine and face mask? Wetin concern agbero with overload? The time wen people wen sabi book produce chloroquine, dem come ask us make we shook mouth for the matter? The time wen dem dey talk consain which medicine dem go take treat lakpalakpa, crawcraw, HIV, cancer, and all the kain sickness wen dey this life, na we follow dem decide? Why dem come dey ask us make we join for the matter on top COVID-19 medicine? Why dem no let those wen sabi argue the matter among demselves, then when dem finish, dem fit tell us? Even the face mask matter too, e come dey do me like say another thing dey inside wen dem no wan talk, because no be only to wear face mask? Wetin hard for there? Just wear am first, see whether e go help reduce the sicky sicky and die die. But dem no gree o. Even the ones wen talk sey dem be pastor. Too muck ITK dey for that America, and as we dey look dem, dem dey go. As I dey write this thing so, na dem naim get the highest number of people wen don sick with this COVID-19, and the highest number of people wen don die too. Their own come even pass the one of China where the COVID-19 for start. See as who no sabi deadbody don dey cry pass owner of deadbody. This thing dey pain me o, because na human beings dey die so. Even if their country no value dem, dem get value to their people, and to God wen create dem. Dem no suppose die like that.

If to say this life balance, na we go dey warn about America. Na we go dey tell our people say make dem shine their eye well well before dem go America. But na condition make crayfish waist bend sha. No be their fault. Na poverty cause am. Na poverty wen our ogas wen dey government for Nigeria wan use take finish us naim cause the insult wen we dey receive for the world. If no be like that, people dey talk, America sef wan talk? I know say we naked, rub potopoto join, come baff for yamayama where pig dey chop, but America sef wear tear tear cloth wen dey smell, and dem no gree baff.

Wetin consain me, abi? Who get load, make e carry e load. Why I go dey take Panadol on top another person headache? E consain me o, make I no lie. I get people for that side. Not only so, if person get headache, the whole body dey feel am, and this world be like one body. When something no correct for one side, even if the other sides no dey feel am yet, small time, dem go feel am. E just be like wen belle dey pain person: no be as you just chop food wen sour finish naim the katakata go just burst. And wen the belle pain start, eye wen get longerthroat for the food, hand wen carry am enter mouth, with the mouth wen chop am, no be dem dey feel the pain pass o. Na belle wen no get any say for the matter, with yansh wen go taya for waterwater shit, na dem dey suffer am pass. Naim be the thing with this America so. When elephants dey fight, grass dey suffer am o.

Photo by Markus Winkler on Unsplash

Naim make I go put small mouth on top the election. So tay people dey fear ballot box snatching and katakata, and people wen dey defend rubbish just dey look am as e dey go? Make people dey see truth talk, especially church people for America. People fit vote who dem like, dem fit support who dem like, but make dem no dey lie inside, and make dem no dey support bad thing. That kain thing dey make Baba God dey vex. No be only abortion dey make God dey vex. Bible talk say God no like who dey carry shoulder up, lie lie, who dey cause gbege, who dey add petrol to fire, who dey take hand kill innocent person. And if una look this matter well, all una hand get blood stain for this matter. Bible still talk say make God pickin no suffer strangers. God say make all Him pickin dey show love, not only with mouth. God talk say make make we be talk na do with our love. If we really want make people know God, no be by gragra, na by love. Church people for America just dey fall hand with the way wen dem dey yarn opata for this election matter. Una fit support who una wan support with una chest, after all, na human being dem be. But no dey lie sey na because una wan help God.  Make una try dey learn too. Read Bible with clear mind, and read history too. Sense dey for who want am.

Photo source: Screenshot from CNN May 31, 2020

America need to dey careful sha. Una dey make me dey laugh sometimes, like when una presido share video of wetin dey happen for place where e be oga, come dey warn people say na so e opponent turn go be. E leave im own dey talk anoda person own! Sometimes, the kain thing that pale dey talk be like ment! Make una check una sef well well; when one man wen dem dey call Joseph de Maistre for olden days talk say every nation get the government wen dem deserve, no be lie at all. For una krokro eyes, una country dey spoil! But no be today the spoiling start. Una matter na case of thief wen thief thief, but no to everything my mouth dey talk. Una sef fit go read una history.

Source: fragilestatesindex.org
Bet e get one thing like that wen dem dey call Fragile States Index. Them been dey call am Failed States Index before, but because dem no want wahala, dem change the name. Since 2016, una score dey go up for that Index. And make una try look una Supreme Court matter. E no good say make who dey judge case dey side anybody. Who dey judge case no suppose dey look face. Even if dem dey side any political party, dem suppose keep that one for their belle, instead make e dey control how dem dey judge any matter wen dey ground. Shame suppose dey catch una on top the Supreme Court levels. As I dey write this thing so, election don dey wan finish. Maybe by the time una read am, dem go don count the vote finish, and we fit don know who win by then. Make whoever win just know say everyday for the thief, one day for the owner. Make una just try to avoid stories that touch.

Problem no dey finish for this life sha, so, on top this election matter, abeg drink water put cup for ground. No go dey do pass yourself. Whoever win, e don win. Make e no pain you too much. Leave that matter for God hand, do the one wen you God don give us make we do. Prayer na must. But prayer no mean say we go let shit dey smell throway face go one corner; we suppose dey shine our eye too, dey see truth dey talk am.

Make I still praise una too. Una dey try o. See as una come rescue una person from kidnappers. Abeg, una do well. Plenty of my countrypeople don miss; the ones wen na kidnappers thief dem dey, the ones wen government sef dey thief or even just kpai, those ones sef dey. Ogoro must still jump sha, so una fit dey help us with our countrypeople wen dey miss too. And if our government dey do anyhow, make una expose their yansh.


Photo by David Todd McCarty on Unsplash

 Abeg, America people, if I come beg una for visa, make una still give me o. Make una no vex o. I just dey see truth talk am. I like una well well, naim make o! Another thing, no to everything una go take do politics. Una see that red colour, abeg, make una let us use am in peace anytime we come una side. No be everything una go kolobi. Shuoooooooo! 


Any which way sha, na God get this world. Na God go still save us last last. Na God get power!

Comments

Popular posts from this blog

AGAINST TIME

DARKEST NIGHTS

I AM A BELIEVER